pidgin nurse Sarah gift

pidgin nurse Sarah gift

Share

welcome to PIDGIN NURSE SARAH GIFT backup page, God's own favourite,chilled zobo is available 😂😂😊😊😊🤗🤗

29/10/2025

Who dey house
Funke: pigdin nurse na me dey house,abeg as i dey so I no dey in the mood,body dey shake me,eye dey turn me,I no get strength to talk o
Pidgin nurse:🤔🤔🤔🤔🤔this symptoms wey you dey tell me be like topic wey I won talk
Funke:Pidgin nurse:wetin you won talk,you don dey turn 🦜🦜🦜
Pidgin nurse: 🤔🤔 hmmm,what a beautiful insult,make I be 🦜
So let gather and learn,today we dey talk about a topic called HYPOGLYCEMIA and wetin e mean

Hypoglycemia (Low Sugar)

Hypoglycemia na when person blood sugar don drop too low. E fit happen to people wey get diabetes or even person wey never chop for long time.

Wetin fit cause am(Causes)

If person use too much insulin or diabetes drug.

If person skip food or no chop well.

Too much exercise without food.

Drink alcohol on empty belle.

Wetin you go notice(Signs and Symptoms)

Shaking or trembling body.

Sweat dey rush.

Head go dey turn or dizziness.

Hunger go catch you strong.

Heart go dey beat fast.

Person fit confuse or faint if e too serious.

Wetin to do(Treatment)

If the person still dey conscious, give am sweet things like sugar, honey, soft drink, or glucose water.

If e no fit swallow, carry am go hospital quick.

How to avoid am(Prevention)

Always chop food on time.

No take diabetes medicine or insulin without eating.

Take only prescribed drugs

Carry small snack or sweet if you get diabetes.

゚viralシalシ
゚viralシfypシ゚viralシalシ

pidgin nurse Sarah gift
I remain your pidgin nurse Sarah gift
Your health is my priority
Go and do a health check upWho dey house

Go and do a health check up

28/10/2025

The champion🏆 of my host above
The captain of my destiny 🙇🙇🙇
In you alone,I make my boast💪💪💪
You reign on high as lord of all🗣️🗣️🗣️

28/10/2025

PTSD (Post-Traumatic Stress Disorder)

PTSD na wahala wey fit happen to person wey don pass through strong or terrible experience like war, accident, r**e, loss of loved one, or any scary thing.

Person wey get PTSD fit dey remember the bad thing all the time, e fit dey fear, dey dream bad dream, or dey behave like say the thing still dey happen.

E fit also make person no wan see people, dey vex anyhow, or no fit sleep well.

Treatment:
PTSD no be jazz — e fit better with correct care. Person need talk to doctor or counselor. Dem fit give therapy or medicine wey go help calm mind and body.

In short:
PTSD na mind wound wey no show for body but e pain pass physical wound.

28/10/2025

Welcome to all my new members
Chilled zobo for you all as you settle down to listen to health talk

28/10/2025

Where we dey🏃🏃🏃🏃
PTSD is a silent killer
Make we gather here learn

PTSD (Post-Traumatic Stress Disorder)

PTSD na wahala wey fit happen to person wey don pass through strong or terrible experience like war, accident, r**e, loss of loved one, or any scary thing.

Person wey get PTSD fit dey remember the bad thing all the time, e fit dey fear, dey dream bad dream, or dey behave like say the thing still dey happen.

E fit also make person no wan see people, dey vex anyhow, or no fit sleep well.

Treatment:
PTSD no be jazz — e fit better with correct care. Person need talk to doctor or counselor. Dem fit give therapy or medicine wey go help calm mind and body.

In short:
PTSD na mind wound wey no show for body but e pain pass physical wound.
゚viralシalシ
゚viralシfypシ゚viralシalシ

21/10/2025

let discuss

Is menstruation 🩸 a dirty blood that you shed every month 🤔🤔💬

14/10/2025

Excess sugar a silent weaker to collagen

pidgin nurse Sarah gift lovers
Do you know that Excess sugar age your skin faster more than sun,it damaged the collagen in the body 😱😱😱😳😳😳
Ask me how
oya let see the answer in the comments session
I'm pidgin nurse Sarah gift
healthy living is my priority

one of the advantages of following this my page is that you can message me on my direct line for medical and health cases

talk
I remain pidgin nurse Sarah gift

14/10/2025

where are the lovers of pidgin nurse Sarah gift
make we go form round table
make we see wetin dey for us today
Today we go dey talk about wetin oyinbo call HYDROCEPHALUS 😂😂😂🤣🤣🤣,who say nurse don come with big grammar,no fear I dey with una 💯
so let me look into
Hydrocephalus
Hydrocephalus na condition wey happen when water (brain fluid wey dem dey call cerebrospinal fluid) too plenty for inside person head. Di water go dey press di brain, make di head swell, especially for small pikin dem.
Cause:
Water no fit comot well from brain.

Too much water dey produce.

Something block di road wey di water suppose pass.

Sign and Symptom:

Big head (for baby).

Head pain.

Eye go dey look down (sunset eyes).

Vomiting.

Baby no go like chop, go dey weak.

Adult fit get balance problem, memory wahala, or trouble to walk.

To avoid born pikin wey get hydrocephalus, woman fit do these preventive things:

1. Go for antenatal checkup well-well:
Make woman dey go clinic early and steady so that doctor fit check if anything dey wrong with the pregnancy.

2. Take folic acid before and during pregnancy:
Folic acid dey help prevent brain and spinal cord problem wey fit lead to hydrocephalus.

3. Avoid infection for pregnancy time:
Infection like rubella, toxoplasmosis, or syphilis fit cause hydrocephalus. Make woman no eat half-done meat, wash hand well, and no near person wey get infection.

4. Avoid alcohol and drugs:
Any woman wey wan get belle or don get belle no suppose dey drink alcohol or take hard drugs, because e fit affect how the pikin brain take form.

5. Prevent head injury for pregnancy:
Make woman dey careful, no make she fall or get accident wey fit affect the belle.

6. Treat malaria, fever, and infection quick:
If woman get fever or malaria, make she go hospital early. No use any drug without doctor advice.

7. Do ultrasound check:
The scan fit show if pikin head dey develop normal or e get water, so doctor fit plan early treatment

Treatment:

Doctor fit put one small pipe (dem dey call am shunt) to help carry di water comot from brain go another part of di body.

Sometimes dem fit do surgery to open road for di water to pass well.

If dem no treat am:

E fit damage brain, cause blindness, seizure, or even death.
Una don see this kind of case before
Sarah Ufot
゚viralシfypシ゚viralシalシ

゚viralシalシ

14/10/2025

To my new fellowers I 💕💕💕💕 you
welcome Iniobong Udo , Matthew

13/10/2025

welcome Catherine Peters
welcome on board

Want your business to be the top-listed Beauty Salon in Lagos?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Website

Address

Lagos